- Author, BBC Travel
- Role,
From di chewing gum coloured lakes for Australia to di solar powered safari camp for Botswana, dis na BBC tori pipo top destinations dis year.
Travel get power to connect inspire and even transform pipo. Di experience dey show how interesting di world be. But even as travel suppose be force for good, di last year don show us say e fit overwhelm or harm di places wey we love, and many destinations don dey sama new restrictions as dem dey handle di effects of overtourism.
For dis BBC first guide to di best places for di world to travel dis year, we wan torchlight di places wey dey face di opposite wahala. All of dis 25 places no dey only welcome visitors and dey offer ogbonge travel experiences but also use tourism to take support local communities, protect di environment or preserve cultural heritage. We gada di list wit di input from BBC Travel tori pipo and some of di leading sustainable travel authorities for world like di United Nations World Travel Organization, Sustainable Travel International and di World Travel & Tourism Council.
As tourism for many regions don increase pass pre-pandemic levels, and extreme weather and climate change don dey show say many bucket list locations no go dey for long again, to travel thoughtfully mean say to reason wia you dey go wey go do beta.
From trekking for moonlike landscape for Bolivia to Arctic glamping for Greenland for di biggest island for world, your next ogbonge adventure dey for front.
1. Dominica
If you wan swim beside sperm whales, Dominica don organize ethical, sustainable way to take do am as part of di Caribbean island commitment to marine conservation and regenerative tourism. Di island nation recently establish di world first sperm whale reserve to take protect di animals. Limited permits for whale swims make sure say di encounter dey intimate and respectful and offer visitors once in a lifetime experience wey go allow research and create sustainable tourism opportunities for local residents.
New for 2025, dem don arrange expanded infrastructure and systems to welcome visitors wey include digital immigration forms to ease arrival and di development of cable car system wey go take pipo from Roseau Valley go Boiling Lake wey be one of di world largest thermal springs. E also dey more easy to go dia. Apart from di American Airlines flights from Miami, United Airlines dey start direct flights from Newark wey go start from 15 February.
Dominica dey also house Project CETI, wey be di ogbonge effort to decode whale language, clicks and codes wey di National Geographic Explorer David Gruber dey lead.
Visitors fit enta hidden gorges, waterfalls and chop local food for places like farm-to-table Lacou.
Dominica no be destination, na movement to support a model of eco-tourism wey dey balance biodiversity conservation wit economic growth, to make sure say your adventure dey protect dis natural paradise for generations to come.
2. Naoshima, Japan
Di Japanese island of Naoshima, na di home of one of Yayoi Kusama iconic yellow, polka-dotted Pumpkin sculptures wey don make am a must see destination for pipo wey like contemporary art and architecture.
Di island wey bin dey known (if at all) for di highly polluting copper smelting industry, di change of di island dey thanks to Benesse Art Site Naoshima wey don help to build major museums and site specific artworks for di beautiful (and population reducing) Seto Inland Sea wey dey between Japan main island of Honshu and Shikoku.
Spring 2025 go see di opening of di Naoshima New Museum of Art, wey Tadao Ando, di award-winning architect wey create nine oda projects for di island.
Dis new showcase wey be for works by Asian artists go be major highlight for dis year Setouchi Triennale wey get events and unveil artwork wey scata across 17 islands and coastal areas for di Seto Inland Sea.
Di event dey happun ova 100 days and dey divided between spring, summer and autumn so visitors go fit enjoy di region through di different reasons. Dis na di biggest iteration of di Triennale since e start for 2010.
Di festival and activities of Benesse Art Site Naoshima na im be di koko to how Naoshima and oda neighbouring islands for Teshima and Inujima take make money,
Book ahead so you go fit visit Rei Naito and Ryue Nishizawa Teshima Art Museum wey be one of a kind combination of art, architecture and nature. For Inujima, travellers go like di remains of one historic copper refinery wey dem make into ogbonge scale art installation. Beta places to stay as hotel na Roka for Naoshima and di Espoir Inn on Teshima.
3. The Dolomites, Italy
If Italy dey your bucket list for 2025, instead of di overtouristed capital Rome, consider to go to di north to di Dolomite Mountains.
For Italians, di rugged beautiful Dolomites na for family fun and luxury holidays. Dem dey go evri year to do skiing, hikes, and Alphine food but overseas travellers dey to check am but e dey poised to change.
Di “Queen of di Dolomites”, Cortina d’Ampezzo, dey listed to co-host di 2026 Winter Olympics. Di preparations wey go hold throughout 2025 go get plenti infrastructure improvements for di area wit pre-Olympic buzz.
But di Dolomites na ogbonge destinations for all seasons, you fit go oda seasons apart from winter to enjoy trails like di 2024 new Cammino Retico (Di Rhaetian Way); a 170km, seven-day trail wey go connect remote villages between di Veneto and Trentino regions. And for pure relaxation, di luxury Aman Rosa Alpina hotel go do grand reopening for 2025. Dem get 51 guest rooms and suites, two presidential suites and di private Chalet Zeno.
4. Greenland
Nowia for earth be like Greenland wey be di world biggest island wit population of less than 57,000. E dey covered by ice caps and ogbonge mountains, dia unspoiled wilderness and majestic fjords no be just anoda geopolitical entity, e also get adventures for life.
For summer, hiking and whale watching na im dey to do and for traditional dog sledding and di magical aurora for winter, na im make Greenland ogbonge destination.
Till now e dey hard reach am but dem dey open new international airport for di capital city for Nuuk and two more to come for 2026. Greenland don adopt di pledge “towards better tourism” and new law wan steer funds from tourism to benefit local communities.
Nuuk na modern town wit a historic waterfront, informative museums and impressive art galleries. Na also di launchpad for hiking, fishing and glamping trips and na di gate to explore di Arctic territory.
For di north for Ilulissat, visitors fit find di icebergs of Disko Bay and di Unesco-recognised Icefjord. For di south, for region wey Vikings bin dey stay, na beautiful fjords and beautiful green hills wey dey wit sheep farms.
– Adrienne Murray Nielsen
5. Wales
Even though e dey six times smaller dan England and dem no dey visit am like dia UK counterparts, Wales get plenti stunning national parks, medieval castles and basically no crowds.
For dis new year, visitors get anoda excuse to visit Wales as dem dey celebrate 2025 as di Year of Croeso (“Welcome”).
Di year long event go showcase di Welsh culture, language and attractions as dem dey invite visitors to “Feel di hwyl” wey be untranslatable Welsh word wey describe deep state of joy wey dey come from being inside di moment.
In recent years, Wales don position demself as di forefront of sustainable, culturally focused travel.
Tourism don get help revive di Welsh language and di nation dey di middle of multi year £5 billion programme wey dey use tourism money to make plenti places to dey more environmentally sustainable.
Bicos of di Year of Croeso, Wales dey invest in mobility bikes so di adventure seekers to explore dia wild side. Wales na also home to di Wales Caost Path wey be di only hiking path for world wey go di whole length of di kontri coastline.
6. Western Newfoundland and Labrador, Canada
Labrador wey be di mainland portion of Newfoundland and Labrador, Canada na vast, rugged region wey dey known for its windswept coastal villages, towering icebergs, subarctic forests and massive waterfalls wit ova 9,000 years of human history.
For 2025, dem dey finish di last stage of di 1,200km Trans-Labrador Highway wey cost 25 years and $1bn to build go make di space more accessible.
Dis new circular route wey dem call Expedition 51 connect Labrador wit five Canadian provinces and get road to di US and even France (via St Pierre and Miquelon).
Canada goment don invest $180m for Parks Canada sites in Western Newfoundland and Labrador to encourage sustainable tourism.
For 2025, Red Bay National Historic Site, a Unesco World Heritage Site and former Basque whaling station go start new visitor centre, L’Anse aux Meadows wey be di first Norse settlement for North America wey dey increase dia ecological protections and upgrading visitor facilities while Gros Morne National Park go get new new exhibits wey go torchlight di parks dramatic geology, wildlife and landscapes.
7. Tucson, Arizona, US
For 2025, Tucson dey celebrate di 10th anniversary of wen e bicom di first city of di US to collect Unesco City of Gastronomy distinction, and also di 259 year birthday of di city.
Di area wey dem dey call Tucson now bin dey part of Mexico at first and e get unique multi-national history, and deep Native American culture wey dem dey celebrate wit free event for di 23 August. E go get traditional Mexican music and dancing for di Presidio San Agustin del Tucson.
Visitors fit go dia desert hiking trails and historic buildings like di 250-year-old San Xavier del Bac, di so-called “White Dove of the Desert”. Dis kain preservation na wjy di city go get di Sustainability Index Award from di Global Destination Sustainability Movement (GDS) dis year.
Di gardens near am get di historic title for being di oldest continuously cultivated soil for di US. Four thousand years ago di ancestors of Tohono O’odham bin dey farm thousand years ago, the Tohono O’odham’s ancestors farmed for dia.
Afta dem mix wit Mexican and indigenous flavours ova di centuries, many of dis olden days herbs and crops still dey ground around di city. You fit chop dia city unique foods for one of di city-of-gastronomy-certified restaurants or Heirloom Farmers Markets, wey dey normally get unique local ingredients like chiltepin chilis, edible cacti called nopales and prickly pear.
8. Western Australia
Perth dey known as di world most isolated big city. Perth and di state of Western Australia (WA) don dey tanda for side wen dem dey call east coast cities of Melbourne and Sydney.
But as e be Australia only direct flights to Europe, Perth don tanda as Australia western gateway and global aviation hub as dem dey redevelop di Perth Airport wit $5bn to enhance di travel experience. And wit new new connections to Asia, WA dey ready to bicom must visit destination for 2025.
Apart from di new cool Perth and dia beautiful Swan Valley Wine Region, WA landscape get ova 2.5 million sq km, wit 12,500km of pristine coastline, pink lakes, horizontal waterfalls, towering karri forests, wildflowers, wineries and wildlife encounters like swimming wit whale sharks and snapping selfies wit quokkas wey dem dey call “di happiest animal for di world”. You fit explore di whole tin for di new 6,600km Electric Vehicle Highway, wey be di longest EV charging network for world.
WA dey also ginger dia rich cultural heritage wit di A$20m Jina Aboriginal Tourism Action Plan wey dey support real Indigenous-led experiences for travellers plus Indigenous business development. Pesin fit learn about di oldest living cultures for Earth wit truth-telling walking tour for Rockingham or one 4WD tag-along coast foraging tour wey go end wit bush barbecue for Broome.
Wit ancient photographs for Murujuga National Park (under consideration for Unesco World Heritage status for 2025), new disability-friendly infrastructure and equipment for di Houtman Abrolhos Islands, boutique hotels in Fremantle and tiny dream stays for di Great Southern and WA go soom change travel for Australia dis year.
9. Sri Lanka
From di hilltop tea plantations and wild elephants wey dey roam to di ancient temples and rolling surf, Sri Lanka na one kontri wey tick plenty boxes. In April 2022, di former prime minister announce Sri Lanka bankruptcy, but di new president aim to rebuild di kontri fortunes afta di pandemic and civil unrest hit dem.
Di resilient island nation dey hope to get back on dia feet through tourism. Di city of Kandy go see di opening of dia first seven-star hotel, Aviyana Private Chalets, while Aarunya Nature Resort get new family villa wey include oculus for stargazing. Dem go open $1bn megaresort for Colombo, and di launch of Sri Lanka new airline Air Ceilão, wey go fly as far as Europe and Australia. Di nation also recently launch di Good Travel Seal initiative, wey dey celebrate local businesses wey don adopt sustainable practices.
Visitors wey dey look for cool location fit take train to di mountain, or travel to Colombo and Galle to discover new generation of mixologists wey dey put dia spin on arrack, one 5th-Century drink. Di island also open di 300km Pekoe Trail, wey dey take hikers through tea plantations and rural villages in di Central Highlands. For pipo wey wan cover more ground, innovative startup allow travellers to drive tuk-tuk across di island, di money dey enta di owner hand directly
10. Panama
Afta managing di Panama Canal for decades, di US hand control ova to Panama by di end of 1999 for one treaty wey late US President Jimmy Carter sign. Dis year mark di 25th anniversary of Panama sovereignty ova dia Panama waterway, and as President-elect Donald Trump hint dem fit possibly use military force to reseize am, series of new permanent exhibits di landmark Museo del Canal highlighting dia path to Panamanian rule feels especially timely.
Yet, plenti tins dey to see for dis nation of big jungles, fine islands and high forests beyond di canal. In 2024, di Meaningful Travel Map to Panama launch in partnership wit non-profit Tourism Cares to make am easier for visitors to find local travel experiences across di kontri.
Afta you start your Localinpty tour through Panama City Casco Antiguo and El Chorrillo neighbourhoods, go to south-west to di La Pintada district, wia artists dey weave fibers to make traditional Panama hats by hand – Unesco-recognised practice wey dem dey call sombrero pintao.
For El Valle de Anton (one of di best community tourism villages by UN Tourism in 2024) you fit go to di forest for Cerro Gaital Lookout Trail wia you fit see both di Pacific Ocean and di Caribbean Sea on clear day from di summit. Dis newly open path dey part of Panama ongoing 1,000 km of Trails project, wey seek to boost sustainable tourism for rural communities while bringing hikers face to face wit Panama staggering biodiversity.
11. Rif Mountains, Morocco
Mountains wey snow cover, sweeping deserts, ancient cities and rich cultural heritage don make Morocco one of di popular destination for North Africa.
But di Al Haouz earthquake of September 2023 devastate parts of Marrakech and di Atlas Mountains, e also impact dia tourism badly. As Morocco kontinu to build (and rebuild) dia tourism infrastructure for di preparation for co-hosting di 2030 FIFA World Cup, di nation dey aim to double dia tourist arrivals in di next five years.
You fit bypass di crowds by taking road trip through di Rif Mountains in Morocco less-frequented northern region. Di 2025-2027 plan expansion of Morocco High-Speed Rail (HSR) network go create multitude of new train lines, including link from Rabat to di ancient, 1,300-year-old walled Rif Mountain city of Fez; home one of Unesco World Heritage medina and di host of several games in di Africa Cup of Nations 2025. From Fez, di 65km drive north to Moulay Idriss, na one ancient hilltop village close to non-Muslims.
Pass through olive and almond groves and mountain villages for stop in Ouezzane – di centre of Sufism – den continue north to Talassemtane National Park to hike through cedar forests, climb craggy red peaks and dive into natural swimming holes. Further north is di town of Chefchaouen, known as di “Blue Pearl” for di blue-painted buildings and streets. Finally, cruise along Morocco northern coast, unwinding in sleepy Mediterranean fishing villages like El Jebha and di white-washed Spanish colonial buildings of Tetouan.
12. Bradford, England
Di northern English city of Bradford go finally fit come out of di shadow of di giant Yorkshire neighbour, Leeds, as e take im place as di 2025 UK City of Culture.
One fabulous year-long programme of events include di re-opening of di National Science and Media Museum, plus innovative celebrations of local cultural icons: more dan 400 work by Bradford-born artist David Hockney hold in Unesco World Heritage 1850s mill; new digital take on fantasy world dream up by di famed literary Brontë sisters; and musical programme mixing electronic bassline symphony, old factory folk music, brass bands and South Asian sound.
Di diversity dey show di eye-opening variety of city wit historic places like Little Germany – wia 19th-Century Teutonic wool merchants build di neoclassical warehouses – One special energy also dey come from di local residents wey represent diverse backgrounds (and youth – most wey be under 20 years old).
Bradford historic streets and di rugged kontri setting dey help di city become Britain first Unesco City of Film (praise wey odas like Rome, Sydney and Busan dey share) – Dem hold some feems for di place such include BBC series like Peaky Blinders and Gentleman Jack, and classic fems like The Railway Children and Wuthering Heights.
And dis year, interactive cookbook project, dey to celebrate recipes from local communities and show dat for 2025, Bradford na truly destination to please all tastes.
13. Jordan
Home to some of di world most breathtaking desert landscapes and di ancient capital of one of history most mysterious civilisations, Jordan neva fail to come up wit wonder.
But take closer look and you go find say di kontri don quietly build up dia reputation as di Middle East go-to destination for outdoor adventure-seekers.
In 2023, one impressive new 10-day, 120km-long hiking path known as di Wadi Rum Trail open, wey weaves through di rust-red walls of Jordan iconic Wadi Rum, tracing di otherworldly landscapes feature in di films Star Wars, Dune and The Martian.
Visitors don traditionally waka through di desert here on 4×4 tours, but dis community tourism project promote slower, more sustainable form of travel wey dey protect di desert delicate ecosystem while e dey safeguard di rich cultural heritage of di local Bedouin community.
Elsewia, dis Maine-sized nation dey teeming wit 33 protected land and marine ecosystems. At di Wadi Mujib Biosphere Reserve (di world slowest-lying nature reserve at 410m below sea level), visitors fit search for di illusive desert-dwelling Nubian ibex while climbing, swimming and sliding dia way through sandstone land to di base di waterfall.
The Dana Biosphere Reserve (Jordan largest), na home to 180 bird species and 25 endanger mammal species. Di rich coral reefs of di Aqaba Marine Reserve, wey IUCN Green List of Protected and Conserved Areas add to dia list in January 2025, support more dan 500 fish species and growing diving scene.
14. Haa Valley, Bhutan
Bhutan wey dey completely lock from di outside world for centuries, dis small kingdom in di Himalayas just begin to dey welcome foreigners for 1974.
Since den e don become global leader in sustainability: Na di world first carbon-negative nation, more dan 60% of dia land dey protected by forest and dem dey measure Gross National Happiness instead of GDP.
Di Haa Valley, pristine forested district along Bhutan western frontier wit Tibet, na di kontri best secret: culturally distinct region wey still dey untouched by mass tourism. Dis Thunder Dragon Kingdom na di last district to open to foreigners in 2002, and today, fewer dan 2% of international travellers dey visit, despite saye get planti field and dey close to Paro International Airport.
E don dey become popular, balancing preservation wit thoughtful development do more visitors go visit.
Travellers fit explore Haa raw beauty through di newly restore 400km Trans Bhutan Trail; di 11km Haa Panorama Trail (revival of one old route); and di two-day Joy Bay Tsho Trek, canopy forests and bamboo farm betwin di villages of Mochu and Youkha.
Haa commitment to sustainable tourism mean say you fit find locally run homestays (and some local hotels) wey dey di centuries-old rural lifestyle. Two distinct, low-impact accommodation also don open: di community-run Katsho Eco Camp, buid along di Haa Panorama Trail by guide and cook wey lose dia jobs during di pandemic, and di luxury Sangwa Camp.
Here, visitors witness local culture, like Bon rituals and rare experiences like breakfast for Bhutan lone strict nature reserve, one highly protected biodiversity hotspot wey be home to rare species like di red panda and snow leopard.
Wit Bhutan Sustainable Daily Fee vision in 2027, dis once- secret paradise dey more accessible while dem remain committed to di low-impact tourism.
15. Hawaii, US
More dan one year afta series of deadly wildfires devastate Maui, di entire state dey experience dramatic downturn in visitors. As families and local businesses kontinu to rebuild, dem don dey ask travellers to return, but make dem do am responsibly.
Enta di Mālama Hawaii programme. Meaning “to protect” or “give back”, mālama na Hawaiian word embodying sense of stewardship and respect for di environment.
As such, di programme dey put travellers for more dan 350 volunteer opportunities, ranging from restoring native forests to sewing and cooking wit Maui families to help to preserve plant and animal habitats on di Mount Kea.
In exchange, travellers dey collect discount – or some dey stay for free – dem dey stay for dozens of hotels and resorts across di islands, including di famous Four Seasons Resort Maui at Wailea wia dem feem di first season of The White Lotus.
16. Uzbekistan
Uzbekistan get one of di youngest populations in di world – more dan 60% dey under 30.
Di kontri wey dey surrounded by young pipo on Tashkent metros, wey double as art museums wit Soviet-era mosaics, you fit see new generation taking over. As di kontri dey strive to maintain im unique traditions and cultures, e dey invest in tourism wit new hotels, train routes, domestic flights and cultural attractions to grow dia economy, retain dia youth and attract more visitors.
Uzbekistan dey get dia first major international biennial wit di Bukhara Biennial in September 2025. Oda major cultural development include expansion of di State Museum of Arts wey Tadao Ando design and di restoration and partial reconstruction of di Palace of Prince Romanov.
As of May 2024, citizens of more dan 90 kontris (including di UK, Canada and Australia) fit visit Uzbekistan without visa. Di president tok say e intend to create Global Green Tourism Startup Lab to bring togada di the kontri commitment to green economy wit tourism. Crossing di border wit neighbouring kontris don become easier. Di region first international railway route, di Silk Road railway tour, launch in November 2024 and now e dey connect Kazakhstan and Uzbekistan.
17. Haida Gwaii, Canada
Haida Gwaii, na archipelago of more dan 150 islands off di coast of British Columbia, e offer more dan wonderful landscapes – e provide one great connection to nature, culture and history.
E dey Isolated from di mainland, di ecologically rich islands na home to more dan 6,800 species, including endemic birds, mammals and plants wey don sustain di Haida Pipo for at least 15,000 years.
Wetin make Haida Gwaii standout destination for 2025 na di groundbreaking Gaayhllxid/Gíihlagalgang “Rising Tide” Haida Title Lands Agreement.
Dis legislation mark one transformative moment for Indigenous rights for Canada, wey officially recognise di Council of di Haida Nation as di territory governing body under federal law. Dis shift dey work to revitalise Haida culture and strengthen dia environmental stewardship.
Visitors fit explore long-abandoned Haida villages like SG̱ang Gwaay, one Unesco World Heritage Site wit ancient mortuary poles and longhouse remains; and see different wildlife like di Haida Gwaii black bear (called taan for di local dialect) and seabirds like puffins and ancient murrelets.
Wen dem land, guests go dey introduced to Haida Laws, including di concept of Gina ‘waadluxan gud ad kwaagid (“everytin depend on everytin else”), one teaching wey really tok about our shared responsibility to care for di Earth.
18. Emerald Coast, Nicaragua
Home to mist-shrouded rainforests, emerald lakes, tower volcanoes and one of di Americas’ oldest and most attractive cities (Unesco-enshrined Granada, wey celebrate im 500th anniversary in December 2024), Central America largest kontri remain one of im least visited. Dat fit change soon wen dem open di new Carretera Costanera: one $400m, 350km-long highway wey link 53 beaches along di nation Pacific Coast, from di Gulf of Fonseca for di north to di turquoise waters of Playa El Naranjo for di south.
Set to dey completed in 2025, di ambitious new infrastructure project make am much easier to shoot south from Nicaragua capital, Managua, to di tropical forests and di world-class surf hubs of San Juan del Sur and Popoyo along di kontri 50km-long Emerald Coast – wey don dey lure in-di-know backpackers for years.
More important, na say di Costanera dey aim to breathe new economic life into di nation, wey be one of di poorest for di Western hemisphere and see im growing tourism sector as key to im economic growth.
Afta one learn to ride wave for one local surf camp and sleep for treehouse for inside rainforest, venture to di Refugio de Vida Silvestre La Flor for di highway southern tip, wia thousands of endangered olive ridley and leatherback turtles lay dia eggs between September and October for one kind once-in-a-lifetime experience.
19. Isle of Man
Despite say e dey ringed on all sides by di UK – Northern Ireland to di west, Scotland to di north, England to di east and Wales to di south – dis cliff-fringed island no actually be part of di Commonwealth.
Instead, tok na say di self-governing isle dey ruled by di world oldest continuous parliament, di Tynwald, and e dey committed to preserve im distinct character and develop one sustainable tourism model.
Flooded wit ancient historical sites, like Cashtal yn Ard (“Castle of di Height”, di largest Neolithic tomb in di British Isles) and Castle Rushen (one of di most complete medieval structures in Europe), di 85,000-resident island decidedly dey forward-thinking. In 2016 e dey recognised as one Unesco Biosphere (di world only self-governing territory wey im entire land and sea area get dat kind designation) for im commitment to environmental preservation and cultural heritage.
Dis year, witness di isle spectacular native bird species for di new Manx Birdlife Point of Ayre National Reserve, wey open to di public in July 2024. Also on tap for 2025 na di 175th anniversary of Okell Brewery, so celebrate dis iconic Manx brew as you take part for tasting tours wey go hold throughout di year.
To addit to learning few words in Manx Gaelic (di island historical language) and familiarise yourself wit di Manx pound (di island unique currency), one of di best ways to understand dis unique British Crown Dependency na to explore am on foot. Take advantage of di isle myriad of organised waka-waka events, hikers go find rolling English fields, misty Irish hills and craggy Welsh coastlines – and dramatic Scottish Highland-esque peaks on di Isle highest point, Snaefell mountain. On clear day, trekkers fit turn in one circle on im wind-whipped summit to see each kontri in di UK and Ireland.
20. Pakistan Gilgi-Baltistan region
Pakistan na one of di World most populated nations, yet e remain one of di great surprise for travellers. Dis fit soon change, as di kontri dey hope one slew of responsible tourism initiatives and new sustainable efforts go attract eco-conscious visitors to explore di breathtaking northern regions; home to five of di planet 14 peaks wey tower over 8,000m – including di world second highest, K2.
Salam Pakistan (Pakistan first-ever national tourism brand, wey launch in 2023) allow travellers to easily apply for e-visas and make bookings on di digital platform, including di coveted mountaineering and trekking visa.
E only take one quick look at di list of mountain peaks and treks to see di scale of Pakistan unmatched adrenaline opportunities.
Yet, Pakistan dey much more dan staggering mountain trails. Di scenic Gilgit-Baltistan region – wey dem dey call “heaven gate” – dey brim wit lush valleys, pristine lakes and glacial waterfalls.
Cradled between trails na Hunza Valley fragrant cherry blossoms and apricot orchards, Swinging Unesco-listed Deosai plains and Shangri-La-esque mirrored lakes. Venture towards di Pakistan-China border to find di Khunjerab Pass, wey go dey operational year-round from 2025.
21. Azores
Maroon for di middle of di Atlantic Ocean some 1,500km west of Lisbon, dis nine-island Portuguese archipelago na one of Europe most isolated destinations and dey known for im steaming natural hot springs, jewel-coloured lakes and sparkling lava tubes.
Di Azores already boast some of di continent most dramatic black-sand beaches and best whale-watching opportunities, but di islands fit now add anoda superlative to di list: Europe largest protected marine sanctuary.
For one groundbreaking piece of legislation approved for October 2024, di Azores newly designated Marine Protected Area go extend 287,000 sq km (one expanse wey large pass all of Great Britain) and safeguard deep-sea corals, sharks and di 28 species of whales and dolphins found here.
Protect di long-term health and biodiversity of dis coral reefs go be beta tin for travellers wey dey eager to participate in whale-watching and sustainable marine research expeditions in di years to come.
Elsewhere, one scenic drive from di capital of Ponta Delgada, Furnas Valley na home to two active volcanoes.
Spend some time hot spring hopping your way across di bubbling geothermal valley, wander through lush botanical gardens or enjoy one leisurely stroll for Terra Nostra Park, arguably one of Europe most beautiful parks.
Dating back to 1775, di eponymous Terra Nostra Garden Hotel na bonafide green retreat wey go offer guests 24-hour access to dia newly enhanced thermal pools and jacuzzis starting in January 2025.
No leave without sampling di cozido das Furnas – one local meat stew underground and slow-cook use di volcanic hot spring natural heat.
Nearby, sample purple volcanic tea for Chalet da Tia Mercês, or plan one visit to di family-owned Gorreana Tea Factory, di oldest (and only) tea plantation for Europe.
22. Kansas City, Missouri, US
Kansas City, Missouri dey make 2025 glow-up year. Di city wey dem sabi as “Paris of di Plains” dey busily promote im creative arts scene and status as one of North America barbeque capitals, all while dem dey launch one urban revitalisation plan wey include new museums, entertainment districts and hotels.
For di heart of di rebrand na di Museum of BBQ, di world first museum dedicated to di art of smoked meat. Slated to open for di Crown Center shopping district for spring 2025, di deep experience go go into Kansas City deep barbeque culture, leading visitors through interactive exhibits for one gift shop wey dey sell all manner of BBQ goods.
Di Berkley Riverfront go kontinu to see new dining experiences, shops and apartment buildings among im incoming development (including one $150m Margaritaville Hotel, di first in di region).
Meanwhile, di Kansas City International Airport dey undergo ogbonge renovations wey go complete for 2025; di $1.5bn expansion go replace outdate terminals and improve passenger flow.
Dis year go also see upgrades to di KC Streetcar; one 3.5-mile Main Street extension wry dey expected to open dis summer wey go make am even easier to reach some of di city premier destinations, including di Union Hill shopping district and di National WWI Museum and Memorial – home to di world most comprehensive collection of World War One objects and documents. And when Rock Island Bridge re-opens in spring 2025, e go become di site of one new entertainment district set 40ft feet over one river.
23. Bolivia
Even if you don already stargaze at di spacelike Uyuni salt flats (di world largest) and trek around di hilly capital of La Paz (di world highest), Bolivia worth visit in 2025. Dis August mark di kontri 200th anniversary and dem dey celebrate wit events and attractions throughout di year for di capitals of dia nine regions.
Visit from 24 February to 5 March for di Oruro Carnival, wey include a multi-day folk-dance parade and don earn Unesco Heritage status for preserving oral tradition.
In Potosí, sip bicentennial singani (Bolivia answer to Peru pisco). Dis strong spirit, now wey be symbol of national pride, don start viticulture for di region in di 1500s for wetin once dey boom mining town – and Potosí still get colonial architecture to prove am.
Bolivia get di largest proportion of Indigenous pipo South America, wit roughly two-thirds of di population directly relate to di area original inhabitants.
Di Guaraní dey among those wey dey live for Bolivia prettiest city Chuquisaca (wey dem also dey call Sucre), wia declaration of independence dey signed for 1825; visit di Museo de Arte Indígena for an up-close look for di kontri ancient textile tradition.
Di Aymara pipo of altiplano dey welcome visitors to di Isla del Sol (an island for middle of Lake Titicaca) wey im moonlike terrain make for one ogbonge daylong hike.
Elsewia, one new network of community-based tourism bring attractions (and work opportunities) to dis sometimes-remote communities, such as di Chalalan Ecolodge in di Amazon Madidi National Park, wia capybaras, cougars and macaws make dia homes.
24. Botswana
Dem don hail Botswana as Africa leader in green safari tourism sake of im expansive wildlife reserves and di govment focus on high-income, low-impact ecotourism policies; one strategy wey don traditionally mean to allow fewer tourists.
But as di kontri welcome new govment and kontinu to recover from di Covid-19 pandemic, im tourism sector (and sustainable cache) only stand to grow in 2025, wit increase demand for sustainable and culturally deep travel experience. For move to boost tourism and strengthen di economy, Botswana don grant visa-free entry to visitors from 104 kontries in recent years – including those from di US, UK, Germany and Canada.
Dis mean more travellers fit now explore Botswana natural beauty, including di “Elephant Capital of di World”, Chobe National Park, and di Unesco-listed Okavango Delta; one vast wetland in di Kalahari Desert wey be one of di world last havens for cheetahs and di black rhinoceros.
Di Okavango Delta go also see one number of new openings, including di 100% solar-powered Mbamba Camp in di delta lagoon-and-savannah-dotted north, one luxury lodge wey dey offer blend of comfort and family-friendly wildlife adventures wey dem plan open in April 2025.
To open in May 2025 na Monachira Camp, wia visitors fit enjoy to dey waka for safaris, mokoro canoe rides and armchair safaris while dem dey come face to face wit elephants, lions and di Pel Fishing Owl.
To start from April 2025, new Air Botswana routes go connect Gaborone to Cape Town, make even easier for visitors to explore Botswana magical nature for demselves – sustainably.
25. Oslo, Norway
“E even be city?” one recent viral ad for Oslo, Norway bin ask. Di tongue-in-cheek video nod to how overtourism don tarnish oda European capitals while dem dey showcase Norwegian kapital extreme walkability; world-class dining; and easy access to nearby fjords, islands and quiet postcard-perfect landscapes.
Wey dey popular for im modern architecture, sweeping waterfront and no shortage of trees (na one of Europe most-forested cities), Oslo dey attract different kind of visitors wey go do dia part to make sure say e remain one of di world most sustainable cities.
Visitors dey encouraged to refer to di Visit Oslo Responsibly guidelines and di Green Oslo Guide, wey break down di concept of sustainable tourism into four categories: planet, pipo, prosperity and partnership. E no be usual tin for hotels in di city centre to feature green roofs wey dey produce food, reduce energy use, manage rainwater and support urban biodiversity.
Travellers fit make sure say dia visit get positive impact on residents and di local environment wit support local businesses like di Norwegian Adventure Company, wey offer “life-changing and sustainable experiences” from dia base in Oslo, like kayaking through glacier-carved fjords, and chasing di Northern Lights.
Afta one long day to explore di spectacular Nordic countryside, dine for one of di city many farm-to-table restaurants, like di Michelin-starred Maaemo, wey dey uses locally grown organic produce. So, na even city? Find out in 2025. – Lynn Brown